Wednesday, 3 August 2011

MORE MUSIC

Yeah, me peeps, I ‘m back. (Market harsh oo but anyhow oguru must jump). Sure you heard about the passing away of a legend, how sad it is when a star falls, our tears pour like water falls, memories flash fast and we ponder on the past life, we will meet again? Will she sing again? Will we ever have another to give us sweet music again, though memories remain, we still feel the pain; as long as we remain her music continues its reign.
Christi essein igbokwe, multi language diva passed away (God bless her soul), I had an experience I’d like to share with you, could you have experienced it too? i told a particular lady about the sad story and our conversation went thus.
Me: men it’s so sad o, you hear say Christi essien igbokwe don delete?
Friend: who be that?
Me: ehh? U dey naija so, how you go say you no know who she be? U no know this song “omo mi seun rere tiye adara o”
Friend: ah na dat woman, ooh eeeyaa, who no know that woman? Chai, why beta people dey die quick ehhn, na that time wey music be music, wey be say before you carry microphone say you wan sing you must sidon write beta thing no be now wey your people dey sing any nonsense wey dem like
Me: my piple?
Friend: shebi you be media persin?
Me: but shebi dem talk say naija no like lyrics na only beat dem wan hear
Friend: if the two good we go reject any one?
Can anybody relate with that? Can I get a witness in the house? (Oh bless you broda, I see you sista, anybody else? Thank you) See my point? It’s a sickening situation. Now tell me how would I have described “Terry” (if you put G na you sabi) maybe the conversation would have gone thus.
Me: men it’s so sad o, you hear say Mr. Brink brink don delete? (Spelling is deliberate, make e no be say I dey find trouble)
Friend: who be that?
Me: ehh? U dey naija so, how you go say you no know who mr brink brink be? U no know this song (demonstrating too) “baby girl make I nak my kpako chaa nak u my kpako , arabarapachamamigrapa cham…chai free me cha…tile tile tile aaaaah free me, make gaga make gaga hihh free me mr. blink blink, she say I dey smoke plenty igbo e no meanoo, e no mean ehh, free me”
Friend: you dey aright?
Me: yes na,wetin?
Friend: na song you say you wan sing, you begin do like say you get demonic oppression.
Me: na him song be that na
Friend: chai , nothing wey persin no go hear for this naija, she na bcos studio don cheap? Every bodi na wey no get work go claim say him be musician, imagine make I flog you my kpako, guy abeg abeg……..
Me: shebi dem talk say naija no like lyrics na only beat dem wan hear
Friend: if the two good we go reject any one
Me: but piple like am now
Friend: even mad man get fans, no imagine I dey smoke plenty igbo wetin him dey teach the youths, guy abeg free me.
I’m not trying to pick a fight; I’m just being honest and reflecting the thoughts of music lovers around the globe. What are the causes? What is the way forward? we will consider these questions in my next write. One music, one world.

No comments:

Post a Comment